Home ๐ŸŽฌ Bollywood ๐ŸŽต Pakistani ๐ŸŽค English Pop

Illusions

๐Ÿ‘ค Brymo โ€ข ๐ŸŽผ Theta โ€ข โฑ๏ธ 5:39
๐ŸŽต 2230 characters
โฑ๏ธ 5:39 duration
๐Ÿ†” ID: 6107490

๐Ÿ“œ Lyrics

You carry boyi go yonder

You say he no go oh
Slavers boku round town
Hin brother tell am oh
Stand for your ground
Make you no hurry follow go
Them dey sell people troway
My brother no go oh
The people them wey go river never return oh
Dem say na mami water
Carry everybody go oh
For full moon, Papa go farm he never return oh
Them say na the forest carry am swallow oh

Listen boyi, life no balance at all oh
You go place you no know
You no go return oh
Boyi feeling true
Him heart dey beat for the road oh
Him fate na to follow dem
Follow journey go

Ah ah ah
Wetin I think I become ah
Ah ah ah
Na illusion dem dey sell you so

Boyi look forth, him look out
No other place to go oh
He carry him few belongings
Reluctantly follow go
For this life we dey
The things you do you know oh
E better to go reach the place find how e dey oh
I talk am, I shout am boyi still dey travel go
Na destiny dey push man where him dey go ah

He try am, he fight am
Urge stronge no be small
The tori e dey the place
Where him dey go ah

Ah ah ahhhh
Na wetin I think I become
Ah ah ahhhh

Na illusion dem dey promise you so

Oga master no wan know how
Value pig fat pass people oh
He say dem be property
With him dog dem equal oh
Boyi clean gun, he shave beard
Oga trust no other
He for adopt boyi, but him people hala
That night boyi take razor he shave am proper
The way Oga dey like am, no touch him moustache ah
Poison for soup, for family and the guards dem
He slash master throat too from ear to ear ah

Ah ah ahhhh
Boyi na most wanted for strange country ah
Ah ah ah
He dey gather soldiers ah
From plantations he dey break boys free

Ehn ehn
My people
The main reason we gather here today
Na him concern us now
Na there we dey go next
Ah today on behalf of the people of the city and the township
The entire tribe and our very very race
We go unveil this statue of boyi
We go give our honorable personality himself
The scissors to use cut the ribbon
For service to humanity
And to race and eh we salute you sir
We salute you well well
Because you really touch our lives
You don change our lives
From generation to generation to come
Nothing go ever remain the same for us
Yes, this statue na the honor of your greatness and service
Thank you

โฑ๏ธ Synced Lyrics

[00:27.27] You carry boyi go yonder
[00:30.79] You say he no go oh
[00:32.01] Slavers boku round town
[00:34.40] Hin brother tell am oh
[00:36.92] Stand for your ground
[00:38.49] Make you no hurry follow go
[00:41.86] Them dey sell people troway
[00:44.32] My brother no go oh
[00:46.93] The people them wey go river never return oh
[00:52.45] Dem say na mami water
[00:54.40] Carry everybody go oh
[00:58.91] For full moon, Papa go farm he never return oh
[01:02.34] Them say na the forest carry am swallow oh
[01:08.00] Listen boyi, life no balance at all oh
[01:12.75] You go place you no know
[01:14.92] You no go return oh
[01:17.87] Boyi feeling true
[01:20.01] Him heart dey beat for the road oh
[01:22.93] Him fate na to follow dem
[01:26.02] Follow journey go
[01:27.23] Ah ah ah
[01:33.91] Wetin I think I become ah
[01:39.84] Ah ah ah
[01:44.78] Na illusion dem dey sell you so
[01:48.89]
[01:59.10] Boyi look forth, him look out
[02:01.78] No other place to go oh
[02:03.88] He carry him few belongings
[02:06.75] Reluctantly follow go
[02:09.24] For this life we dey
[02:11.29] The things you do you know oh
[02:14.24] E better to go reach the place find how e dey oh
[02:19.21] I talk am, I shout am boyi still dey travel go
[02:24.79] Na destiny dey push man where him dey go ah
[02:29.95] He try am, he fight am
[02:32.02] Urge stronge no be small
[02:34.72] The tori e dey the place
[02:37.84] Where him dey go ah
[02:41.18] Ah ah ahhhh
[02:46.24] Na wetin I think I become
[02:50.38] Ah ah ahhhh
[02:56.64] Na illusion dem dey promise you so
[03:00.61]
[03:11.34] Oga master no wan know how
[03:13.49] Value pig fat pass people oh
[03:16.19] He say dem be property
[03:18.35] With him dog dem equal oh
[03:21.44] Boyi clean gun, he shave beard
[03:23.71] Oga trust no other
[03:26.33] He for adopt boyi, but him people hala
[03:31.46] That night boyi take razor he shave am proper
[03:36.45] The way Oga dey like am, no touch him moustache ah
[03:42.55] Poison for soup, for family and the guards dem
[03:47.50] He slash master throat too from ear to ear ah
[03:53.96] Ah ah ahhhh
[03:57.80] Boyi na most wanted for strange country ah
[04:03.19] Ah ah ah
[04:06.36] He dey gather soldiers ah
[04:08.38] From plantations he dey break boys free
[04:12.13]
[04:34.07] Ehn ehn
[04:36.22] My people
[04:37.02] The main reason we gather here today
[04:40.87] Na him concern us now
[04:44.06] Na there we dey go next
[04:45.04] Ah today on behalf of the people of the city and the township
[04:49.96] The entire tribe and our very very race
[04:54.12] We go unveil this statue of boyi
[04:58.46] We go give our honorable personality himself
[05:04.08] The scissors to use cut the ribbon
[05:06.66] For service to humanity
[05:09.15] And to race and eh we salute you sir
[05:15.63] We salute you well well
[05:17.75] Because you really touch our lives
[05:20.10] You don change our lives
[05:21.28] From generation to generation to come
[05:22.54] Nothing go ever remain the same for us
[05:25.29] Yes, this statue na the honor of your greatness and service
[05:31.13] Thank you
[05:32.01]

โญ Rate These Lyrics

โ˜†โ˜†โ˜†โ˜†โ˜†
Average: 0.0/5 โ€ข 0 ratings